Our Duke has gone mad again… Edgar questions move by NLC to embark on a strike

0
123
Edgar

Opinion article by Duke of Shomolu, Joseph Edgar

Na so I dey look dem short President dey talk wetin he no real sabi. Dem don go ahead call strike wey go dey at best ineffective.

Government don call dem bluff, even MC Oluomo don talk say make buses, Keke Marwa and the rest continue dey work. He don even drop price of transport and Sanwo-Olu don do same.

Strike wey no catch Lagos, no make sense because Lagos na the commercial centre. Except dem go block road to Airport or seize Radio Station, I no see the effectiveness of this strike.

Me dey always put NLC and ASUU at the same level. Me dey see them as detached and out of touch organization’s filled with old soldiers wey dey live on the past achievements of Pa Imoudu.

The height of post modern NLC Power na Oshiomhole on this same fuel matter. Oshio Baba hold OBJ down for over 15 days shutting down the country and almost bringing the Government to its knees.

Trillions were lost, the economy suffer, poor people suffer and still we no achieve anything on both sides except Oshio ego wey he come use enter politics come become Governor come marry fine wife.

Wetin NLC no know today be say, things don change. The economy don move from extractive to service and technology and as such the powers no longer dey within them fold.

Dem dey carry textile workers and lecturers and other type of old school laborers dey threaten Government.

Government wey no stupid don see am say NLC power don finish. Dem first pamper dem with small beg, dem no hear, Baba Agbado just call Gbaja say- abeg pour dem dirty water make dem do anything dey like

The workforce is already sitting at home since covid. We don dey used to working off-site, we don open new economic structures wey no dey under NLC.

Authority don dey democraticized  and as such NLC no represent over 80% of work force. NLC na eunuch now, dey really are no longer a force to be reckoned with. Na relic of the past, but dem no want gree.

Ok now Baba Agbado don drop the worst 90 days in presidential history. He don show us clearly say political mobilizer no be the same thing as Presidential administrator.

Years in the political trenches, mobilizing, enthroning and dethroning and generally being a god father no be the same thing as running a country as complex as Nigeria.

READ ALSO: Our Duke has gone mad again… Edgar recalls when his ‘wife’ in Ogba gave him a son

In less than 90 days, he don move us to an economic standstill and not only that don push us near war with another country before he come go Cotonou go sleep on stage.

In response, NLC in its characteristics one sided move, don throw strike into the equation.

Who strike help. Calling out daily paid people to fight a system wey no go budge na to carry pepper rub him own eye na.

NLC no dey even look the issues. The subsidy dey kill us we no fit afford am again but truth be told, in solving the problem, Agbado don mess up and worsen the situation.

So to engage and wrestle stubborn baba down no be strike. Strike time don pass, na to be a little bit more structured.

Na long term strategy to build an effective bulwark for opposition for this country. No be to wake up one morning and give 7 days’ notice for strike den jump on top molue dey do like Sowore all over the place.

Person dey big pass something na.

NLC been start well with the LP, but allow dem Obi take them out. With the LP and that momentum, they for concentrate on putting people inside the National Assembly and State Houses of Assembly.

Then opposition for dey at the level of Legislature so dem go control oversight and regulation.

But as dem no get sense, dem allow branch of PDP collect dem party while dem dey wear Ankara dey jump for main road like Shomolu tout.

Imagine if the original Labour Party pulling in reasonable opposition come control Senate we no for get problem.

But instead, today,  Senate na my town man with him ibibio accent siddon there dey ask pple with 2 credit to bow go become minister.

NLC no really get sense cos if dem get sense, missing the opportunity of the elections for deploy other means of protest, like sit-out infront of Baba office, in front of Governor office, in front of National Assembly and refuse to leave until they are listened to.

That way, we wey na per day job we dey do go continue to do our work when we close, we go join dem for Tinubu house like we do for #EndSars bf he come scatter.

So today as we embark on another futile attempt at relevance by this moribund bunch of masquerades, I call on all Nigerians to ignore NLC and dem mumu strike and go about their daily work cos NLC no go feed your family or bury your dead if stray bullet come.

The God wey save children of Israel from Pharaoh go save us from this Tinubu because this one go pass feast of Passover to conquer but God go save us from this Nebuchadnezzar no be NLC.

When dem get sense, we go join them for now na to ignore them.

Yeye

 *Duke of* *Shomolu*

 *N12*

Disclaimer: Comments or opinions on any part of this blogsite are opinions of the blog commenters or anonymous persons as the case may be. They do not represent the opinion of naijabloggist.com

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here